[Verse 1]
Police don block the motor make nobody come down
We been sit down outside dey argue front of we compound
About Ronaldo, Messi money when we hear the gun shot
We feel say na play till we stroll reach Cynthia mama shop
3 boys mask up kporkpor use them lie ground
Be like film for we eye na better machine na e dem carry
Use police run better race, but as dem reach that sharp turn
Kuti play follow them, who drive na bros Batare
Baby Benz - Sharp onе. Them spray the top black
Beigе interior, this na when that motor newly come
Na one ljaw man them go rob, dem follow am from bank
E just dey go from [?], Shell pay am millions
Them say na one person for plaza na e give them the line
According to who go station wen dey admit the crime
Area don gather for snooker board around nine dey judge
Say Emma fuck up, big man pikin. Which money e dey find?
Around 9 you go see guy man don powder nose
No be say na make up artist if you know, you know
Eye dey red through window dey shele people phone
Wan fire ice as I dey talk na my shoe Dey him leg
[Chorus]
Cocaina patient
Cocaina patient
Trouser dey ground belt Dey waist
Dey talk plenty
Cocaina student
[Verse 2]
I Dey my snooker board dey smoke, you carry problem come
My people no [?] How your matter be?
Na money matter we dey talk and u know say head burn
No worry blood I dey with you, leave everything for me
Swipe right, swipe left na you get choice
Anyhow you wan live your life, na you get voice
You no fit dey motor with me dey say you Dey your lane
Na the same place we two Dey go no use your life do toys
When gen off everybody go remove their phone
Carry their charger Waka - oko na so life be
Carry your passport no be only stand alone
For cofffin na only you - oko use ur IP
[Chorus]
Cocaina patient
Cocaina patient
Trouser dey ground belt Dey waist
Dey talk plenty
Cocaina student