E get many many things wey don sup for my life oo (for my life oo)
I no get shi shi dey say price dey to pay (for my life oo)
Dem dey snow I dey burn candle every night and day (for my life oo)
Na lie if dey call you my blood, all man for himself (for this life oo)
Ayele, ayele, ayele (for my life oo)
I see shege, I see shege, I see shege (for my life oo)
I no see anybody but mama dey pray (for my life oo)
Wahala dey, wahala dey, wahala dey
(for this life oo)
Ah see face me I face you, is where I'm from
Six different families under one roof
For the twelve rooms we get two bathrooms
One for the landlord na the second one tenant dey use
For school, shame no dey catch me again
If dey pursue me for school fees
E no be new thing again
If to say my mama get she go be the first to pay
Or second to pay
But money no dey
No motivation and things wey I see fit make me relent
But like king 24/7 I dey beat my chest
If I go back, mumsy eye go red
Na studio I go why you come dey vex
See the para wey dem dey give me for church
Fapana pastor why you dey sing all this song
Oya cast the first stone if you never sin before
You no go law school oga why you dey judge?
Yeah say I hustle, hustle hustle for a very long time
Dem tell me say make I wait for my time
Now i’m shining up cuz it is my time
Even devil gon no fit stop my shine
Kuronbe, Oya see my life today person wey dem
Downgrade before dey don dey give accolade
Na me know wetin my umbrella see for rainy days
Oya na welcome to my sunny day
Kuronbe, bad girl wey dey hustle all day
Under my dictionary nothing like holiday
Ah but right now we dey bless God
We dey bless God hustle don dey pay
My mama born better pikin
All the girls dey won chop a large chicken
They cannot stop this energy
Zlatan and success boxing again
E get many many things wey don sup for my life oo (for my life oo)
I no get shi shi dey say price dey to pay (for my life oo)
Dem dey snow I dey burn candle every night and day (for my life oo)
Na lie if dey call you my blood, all man for himself (for this life oo)
Ayele, ayele, ayele (for my life oo)
I see shege, I see shege, I see shege (for my life oo)
I no see anybody but mama dey pay (for my life oo)
Wahala dey, wahala dey, wahala dey
(for this life oo)