Erigga
SACRIFICE

[Intro: Erigga]
Ah, You know how dem tell you say, if e no pain you no be sacrifice, right?
Well, thanks for waiting on me
It's paper boi

[Verse 1: Erigga]
Through all the hurt and the pain we still reach this height
Some miss the flight
Baggages too much wan off my light
Weytin I do dem?
Most of the friendship when end na money decide (yeah)
Life no difficult na you say you wan rich
You wan piss, you wan eat where big man dey chop
Nor be with clear eye many of us run leave street
We need the muller throway weytin dem wan dey talk (yea eh eh)
E meet me for road, dey ask why I no dey uni?
I look am smile, big man when get four compound
Make I come around make una gather chichi me?
Nor worry I go dey alright without papa compound

[Pre-Chorus: Erigga]
Go the next story nor be you make me do data
Na boredom everybody get their void to feed
You nor important like story when dey news paper
Tomorrow akara woman nai go use am take feed
[Chorus: Big Klef]
Made it out the trenches
Paid what it cost
Always count my blessings
'Cause we all gat flaws
Say what it is don’t tell me what it was
Pain and the hate, we go still show love
Yea

[Verse 2: Erigga]
Cocaina patient we know all of them
When dey use fake account insult their papa
All for engagement or money when lorlor dey share
Weytin concern me? me when get yanki waka?
I dey area now, tomorrow I dey go London
You nor fit relate you dey area dey smoke London
You see the difference so wey you, CHOP YOUR MOUTH!
We know you reach house, Mumu dey internet dey rant
Wait, Ant wan throw backie for where lizard dey?
Two seconds dem leak am enter belle
Go for your goals, nowadays nor be better keeper dey
Through internet ordinary leg dey whip am enter the goal like cele
'Cause life na bitch, old tele tele
No wonder ofurukpe dey quench am, ha~hhehe
Try make am e no get who you wan tell
Your sad stories nobody get time for such and such
[Bridge: Big Klef]
And all the sacrifices we made
To make sure that the world
Remember my name
They don’t know

[Chorus: Big Klef]
Made it out the trenches
Paid what it cost
Always count my blessings
'Cause we all gat flaws
Say what it is don’t tell me what it was
Pain and the hate, we go still show love

[Outro: Erigga]
I know how excited you are
You are listening to Erigga
Your favourite musician and shit (still show love)
But just know say upon all the things wen we dey go through we still get to give to you, you understand?
Because I dey see like we creators, like, we go through the most pains
Because na that pain we fit dey channel our energy inside the universe when dey make you fit dey connect
It's the G.O.A.T
Seven albums, still strong
Day break, everywhere burst
Abeg