[Intro]
Ah! Yeah!
Bad guys in the building
[Verse 1]
Yeah!
I dey for bed since I dey try move
In my 27 years I never see this kind groove
We dey fight hangover me and my guy Juls
And I no dey smoke so I too dey like booze
You know that kind level wey you don shak to
Wey you see every girl like if I catch you
Lola say she want blaze
Make we come high school
Okay thank you
But me I'm quite cool
I don't know about Juls but use your best effort
I'm a grown man I don't succumb to peer pressure
I shacko I demo
Only for like 10 seconds
For the shortest resistance
I hold the best record
[Pre-Chorus]
Twenty minutes later
Hot don cool down brother
We don stop to bother
Shayo don dey enter
Lola pass the polishi
Make me smoke the claro
I come start to wonder
Send me go for parole
[Chorus]
They don get me
See as fine girl dey wound person
I dey form hard when nobody send me
Chai!
They don get me
Ah! They don get me
See as fine girl dey wound person
I dey form hard when nobody send me
Chai!
They don get me
[Verse 2]
I dey prove hard guy
I dey there dey form stunt
Me wey no dey smoke I don clear one blunt
I dey mix when already sef guys don drunk
The high come dey be like say e go last one month
She give me space cake
She say guy come chop
Ah say gimme space
Wait my heart wan stop
Ah still try comport
Many guys don knock
Me dey like form tough
All my guys don talk
I chop the cake finish
Now I see the light
I dey ask Lola why the sun dey rise in the night
I no know wetin Juls don add to him Sprite
But na Psalm23 wey my guy dey recite
[Pre-Chorus]
Twenty minutes later
Hot don cool down brother
We don stop to bother
Shayo don dey enter
Lola pass the polishi
Make me smoke the claro
I come start to wonder
Send me go for parole
[Chorus]
They don get me
See as fine girl dey wound person
I dey form hard when nobody send me
Chai!
They don get me
Ah! They don get me
See as fine girl dey wound person
I dey form hard when nobody send me
Chai!
They don get me
[Outro]
Ah dey ask Lola why the sun dey rise in the night
Chai!
They don get me
Na Psalm23 wey my guy dey recite
They don get me
Aah! Dey don get me
See as fine girl dey wound person
I dey form hard when nobody send me
Chai!
They don get me